11 As wi dey serve Christ, di woman and di man, dey togeda for Christ body.
Bikos of di angels, di woman must kover en head to show sey na en husband dey protet am.
Aldo God make woman from man, but na woman dey born evribody, even doh na God kreate evribody.
E nor matter weda una bi Jew or Greek pipol, savant or free pesin, man or woman, bikos all of una dey inside one body for Christ.