1 Make una follow mi as I dey follow Christ.
Make una dey do as I dey do; bikos I dey always try to please evribody instead of mysef, bikos I wont make God save dem.
So, I dey enkourage una sey, make una bi like mi.
My brodas and sistas, make una dey live like mi and dey learn from odas wey dey follow us as ezample.
So, una kon bigin do as wi and Christ dey do; even doh una sofa well-well, una receive di message with joy wey di Holy Spirit dey give.
Nor bi sey wi nor get rite to ask una, but wi won use awasef as ezample for una,
So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.