9 So make wi nor tempt Christ as some among dem dey do before snake kon distroy dem.
For di desert, dem bigin put eye for bad-bad tins kon dey test God patient for dat dry and empty land.
Dem dey test God with sturbones for dia heart kon dey tok di kind food wey dem won chop.
But Israel pipol still dey test and sin against di Most High God and dem nor gri obey en laws.
Bikos for der, even doh dia grand-grand papa dem si evritin wey I do, dem still test and try my patient.
So dem komplain give Moses, “Make yu give us wota drink!” Moses ansa dem, “Wetin make una dey kworel with mi? Why una dey test God?”
Moses koll di place Massah and Meribah, bikos Israel pipol komplain and test God wen dem sey, “Yu sure sey, ‘God dey with us?’ ”
Make una nor test di Oga una God, just as una do wen una dey for Massah.