Wen Moses waka near di kamp kon si di melu and di way di pipol dey dance, e vex well-well. E trowey di stones wey dey en hand and dem kon break to pieces.
Aaron kollect and melt di gold kon mold melu for dem. Wen di pipol si di melu, dem kon sey, “Israel pipol, dis na di god wey lead us komot from Egypt.”
but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.
But naw, I dey rite to una sey, pipol wey sey dem bi Christians and dem dey do bad tins, make una nor follow dem make friend. Make una nor even chop with dat kind pesin.
Una nor know sey wiked pipol nor go enter God kingdom? So make una nor fool unasef! Pipol wey dey sleep with who dem nor marry; doz wey dey serve juju; men wey dey sleep with oda men;
Den God sey, “Make yu get up! Just dey go at wons, bikos di pipol wey yu bring out from Egypt don dey sin. Dem kwik-kwik forget kon komot from di way wey I sey make dem dey live dia life! Dem don melt gold take make juju for demsef!”