Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 10:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 But anytin wey una dey do, weda una dey chop or drink, make una do am to honor God.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 10:31
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di pots wey dem take dey kook for Jerusalem and Judah go dey holy before di Oga awa God wey get pawa, so dat doz wey dey kom offa sakrifice, go use dem take kook dia sakrifice. For dat day, di pipol from Kanaan wey dey sell inside Oga God Temple, nor go ever dey for awa God house again.


But make una from una heart give to pipol wey nor get, so dat evritin go dey klean for una.


so e go dey tink about difren tins. Woman wey neva marry dey only tink of how to make belle sweet Christ. Dat time, dia body and mind dey pure. But woman wey don marry dey worry about dis world tins, bikos e wont make belle sweet en husband.


For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).


Una must chop dis tins for di Oga una God present and e go bi for di place wey E choose. Make una chop for der with una shidren and Levi wey dey stay with una and for evritin wey una dey do, make una dey celebrate for di Oga una God present.


For der, una with una family go chop for di Oga una God present and una go happy for evritin wey una get, bikos di Oga una God don bless una.


For anytin wey una dey do, weda una dey tok or do oda tins, make una do am with awa Oga God Jesus Christ name and tank God thru am.


Anytin wey una dey do, make una do am with all una body, like sey una dey do am for Christ and nor bi for pipol,


Pesin wey dey prish; make e prish God word well. Pesin wey dey help odas, make e do am with di pawa wey God gi-am, so dat for evritin, God go get glory thru Jesus Christ. Make all glory and pawa bi Christ own forever and ever. Amen!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ