Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 10:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 Bikos God word sey, “Di eart and evritin wey dey inside, na di Oga God own.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 10:26
9 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Who don give mi anytin kon sey make I pay back? Evritin wey dey under heaven na my own?


Na God get di eart and evritin wey dey inside. Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.


If to sey I dey hongry, I nor go tell una, bikos na mi get di world and evritin wey dey inside.


And naw, if una go obey and keep my kovenant, una go bi special pipol wey I selet from di oda pipol for dis world, bikos na mi get di whole world.


Moses ansa am, “Wen I komot go inside town I go stresh my two hand go heaven to di Oga wey bi God, den di tonda go stop and di ice-blok nor go fall again, so dat yu go know sey na Oga God get di whole world.


But if di pesin tell yu sey, “Dem sakrifice dis food give juju,” make yu nor chop am bikos of di pesin wey tell yu and en konscience.


Di heavens, di heavens wey high pass, plus di eart and evritin wey dey inside am, na God get all of dem.


Bikos evritin wey God kreate, dey good and wi nor suppose rijet any food, so-far wi don tank God for am,


Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ