Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 10:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Pipol sey, wi fit do evritin. Dat na true, but nor bi evritin dey good. Wi fit do evritin, but nor bi evritin dey good for di body.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 10:23
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Bikos if di food wey yu chop make yor broda or sista vex for yu, den yu nor dey show love again. So make yu nor let di kind food wey yu dey chop, offend di pesin wey Jesus Christ die for.


Na so e bi with una too. If una really wont di gift wey di Spirit dey give, make una choose di one wey di church go gain from.


Una fit really dey woship God well-well, but nobody go gain from am, bikos dem nor undastand wetin una dey tok.


My friends, wen una gada to woship, una must do evritin to help one anoda. Na so e suppose bi wen somebody dey tish, sing, profesai, tok with difren-difren language or dey esplain wetin di pesin tok.


Some among una sey, “Wi fit do anytin wey wi wont.” But I dey tell una naw sey, nor bi evritin dey good for us. So I nor go gri make anytin kontrol mi.


For di leta wey una rite, una ask mi about juju food. And all of us know sometin koncerning dis matter. But if wetin wi know, dey make us dey proud, den bikos of love, wi suppose help one anoda.


But make una dey kareful, so dat weak pesin among una nor go fall bikos una don dey free to chop anytin.


May bi una dey tink sey wi dey tok dis tins to defend awasef. No! Wi dey tok to una like dis as Christ savant and na God bi awa witness. Evritin wey wi dey do, na to make una strong.


Make una nor allow any bad word kom out from una mout, but make una word dey give poor pipol hope, so dat e go bless pipol wey hear am.


So make una dey enkourage and help each oda, just as una dey do naw.


but dey waste oda pipol time with di words wey dem dey tok. Dis kind tin dey make pipol live yeye life, instead of to dey hear God word wey dey make pesin faith strong.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ