Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 10:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 10:22
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Judah pipol sin well-well and dem kon make God vex pass as E vex for dia grand-grand papa.


God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.


Dem dey make God vex as dem dey build shrine for oda gods; dem really make God jealous with dia juju.


Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.


Una must nor woship any oda god, bikos di Oga God wey en name na Jealousy, na God wey dey really jealous.


Evritin wey dey happen, na wetin God don sey go happen and all of us know sey, yu nor go fit argue with pesin wey strong pass yu.


E nor go betta for di pesin wey dey argue with di Pesin wey kreate am! Pesin wey bi like ordinary pot for where oda pots dey for groun. Klay fit tell who dey use am sey, “Wetin yu dey do?” Abi di pot wey yu dey make fit sey, “Yu nor know work at-all?”


Why una dey woship juju and sakrifice give Egypt gods? Na bikos una dey stay der? Abi una nor know sey una dey make mi vex? Una dey distroy unasef and na dis make all di nashons for di eart dey trit una anyhow kon use una name as curse!


Na mi, dem tink sey dem dey do? ‘No!’ Na demsef dem dey bring wahala and shame kom meet.”


Wen I don finish with una, una tink sey una go get strent or pawa to karry una hand? Mi God don tok and I go do wetin I tok.


Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.


Dem make am jealous, bikos dem dey serve juju and oda gods.


Dem don make mi dey vex for di gods wey dem dey serve; dem don make mi dey vex well-well with tins wey nor mean anytin: So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense.


Di Oga una God na strong fire wey dey burn anytin and E dey jealous well-well.


bikos di Oga una God wey dey here with una, dey jealous well-well and en vexnashon go kill and porshu evry oda tin, until E go distroy wiked pipol and sinnas komot from dis eart.


Na big wahala if pesin fall enter God ponishment!


Joshua kon warn di pipol, “Una nor go fit dey woship God as E wont, bikos E dey holy. E dey jealous and E nor go forgive una if una turn from am kon sin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ