Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 10:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Bikos wi dey chop from one bread, all of us don bi one body, even doh wi many.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 10:17
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na so e bi with us. Wi many, but wi bi difren parts for Christ body and wi bilong to each oda.


Yu nor fit drink from God cup and demon cup for di same time.


Christ body get difren part like evry oda body.


All of una dey Christ body. And each of una, na part for di body.


So, bikos of di gospel, Gentile pipol don follow Jew pipol get share for God blessing. Dem don bi membas for Christ body and dem get share for God promise.


Na from Christ di whole body dey grow well and join togeda thru di pawa wey dey support am. As each part dey do en work, na so di body go dey grow inside God love.


Since una don stop to lie, make una start to tok trut give una neighbour, bikos all of us na membas for Christ body.


Na one body and Spirit dey, bikos just as all of una get one hope from God wen E koll una,


Dat pesin nor dey with Christ wey bi di head. Bikos na Christ join di whole body togeda, as dem dey grow inside God.


For heaven, e nor get anytin like Greek or Jew pesin; pesin wey dem sekonsaiz or not; bush pesin; pipol wey dey chop human being; slave or free pesin, but na Christ bi all and e dey inside all of us.


Make Christ peace dey rule una heart (bikos na thru dis peace, Christ take koll una as one body) and make una dey tank God.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ