Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 10:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Dem rite dis tins wey happen to dem to tish us lesin and na ezample for doz wey go dey wen di world go end.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 10:11
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dat nite, di girls kon make dia papa drink well-well and wen e don high and e nor know wetin e dey do again, di junior dota kon sleep with am.


So, make una rite dis tin down for una shidren-shidren, so dat wen dem born dem, dem go praiz God.


Wen I vex kom ponish una, all di nashons near una, go fear. Dem go shake dia head and laf as dem dey look una.


and di enemy wey plant dem, na di devil. Di harvest na di last days and di harvest workers, na di angels for heaven.


“Just as dem gada di grass burn dem for fire, na so e go bi for di last day.


Since una know di time wey wi dey naw, make una dey bihave well, bikos di time don rish wen una go wake-up from sleep. Una know sey di day wey God go give us salvashon, don near well-well pass as e bi wen wi first bilive.


Nite don nearly finish and day go soon break. So make wi stop to bihave like pipol wey dey darkness and make wi ready to waka for lite.


Bikos evritin wey dem rite from biginnin, na to tish, enkourage and give us hope.


Even doh God koll am “Raitious pesin”, E tok dis word bikos of only Abraham?


Naw, all dis na ezample for us, so dat wi nor go do bad tins as dem do,


My friends, wetin I mean bi sey Christ go soon kom and e nor matter if yu don marry or not.


No! Na wi God dey tok about. Dem rite all dis tins for di law, so dat evribody wey work, go fit chop for harvest time.


Betta sense dey for dis story, bikos dis two wimen bi like two kovenant. One na from Mount Sinai wey bi like di shidren wey Hagar, di slave woman, born.


Make evribody know sey una nor like wahala, bikos Jesus go soon kom.


Make wi nor stop to dey meet and fellowship togeda, as some pipol dey do, but make wi enkourage one anoda more-more, since wi know sey, “Di Day wen Christ go kom,” don near.


Bikos God word sey: “E nor go tey again before di Pesin wey dey plan to kom, go kom.


My shidren, di world don dey end and just as una hear sey, anti-Christ dey kom, make una know sey many anti-Christ don already kom. And dis show us sey di world go soon end.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ