Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Korintians 1:28 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

28 Wetin di world tink sey nor good, naim God choose; tins wey dem tink sey nor mean anytin, na doz tins E make important.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Korintians 1:28
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E nor nid pesin to tell am anytin, before E go remove leader kon put anoda pesin for en post.


Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.


Di day dey kom wen God go honbol proud pipol kon disgrace sturbon pipol. Den na only God, pipol go dey praiz.


For dat day, God go distroy doz wey dey karry body up kon disgrace sturbon pipol and na only en name pipol go dey praiz.


So God angel go Assyria kamp for nite kon kill 185,000 sojas. All of dem die before day break!


God word sey, “I don make yu papa for many nashons.” So for God eye, Abraham na awa papa, bikos e get faith for God wey get pawa to raiz pipol wey don die and to kommand tins wey nor dey before, like sey dem dey.


Wetin happen to di wise pipol? Wetin happen to doz wey know Moses Law well-well? Wetin happen to doz wey tink sey dem get all di ansa? Abi God nor sey dis world wisdom, nor mean anytin?


Wi dey tok with wisdom to doz wey really know God word, but nor bi with dis world or any ruler wisdom, bikos dia wisdom nor mean anytin.


I don turn to fool! Na una force mi, bikos una suppose to praiz mi. Even if I nor bi anytin, e nor get anytin wey doz una “supper apostles” take betta pass mi.


Just as e sweet God to prosper and make una plenty, na so too God go dey happy to distroy una. “E go remove una from di land wey una won enter go stay,


Den evribody go know who dis wiked man bi and God go distroy am with breeze from Christ mout kon beri am with di glory wey dey kom.


So as di shidren get flesh and blood, en too get flesh and blood like dem, so dat thru deat, e go fit distroy Satan wey get pawa to kill


Bikos na only one hour God take distroy dis big town finish!” And evry ship, dia kaptain and pasenja, plus evribody wey dey work for sea, go stand far,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ