Evry word wey wi dey tok, na God Spirit tish us and nor bi human wisdom. Na dis same Spirit dey help us tish spiritual tins to pipol wey get God Spirit.
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.