Wen Rebekah hear wetin en senior pikin, Esau tok, e koll en yonga pikin Jakob kon tell am, “Si, yor broda Esau dey try to revensh, so e don sey e go kill yu.
Na Jakob story bi dis: Josef wey bi seventeen years dey kare for di sheep with en brodas. Naw e bi small boy wey dey work with en papa wifes, Bilhah and Zilpah sons. Josef kon tell en papa bad tins about dem.
Wetin I hear bi sey, some of una dey sey, “Na Paul side I dey” odas sey, “Na Apollos side I dey” some still sey, “Na Pita side I dey” or “Na Christ side I dey.”
bikos una neva get di Spirit since jealousy and kworel still dey among una. Dis mean sey una neva get di Spirit and una still dey live like pipol wey dey di world.
Bikos I dey fear sey wen I kom, I nor go like wetin I go si and una nor go like as I go tok. I dey fear sey una go dey kworel, dey jealous each oda; dey vex; dey tink of only unasef; dey tok bad about each oda; dey do aproko; dey karry body up and dey bihave anyhow.
Nor put mout for word wey nor dey good: like matter wey koncern who born who and kworel or fight about Jew pipol law. All dis tin dey yuzles and dem nor mean anytin.