Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 9:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 But if yu and yor shidren-shidren stop to follow mi kon disobey di laws and kommand wey I give, den bigin follow oda gods,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 9:6
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga wey bi dia God kon break di agriment wey dem make. Dem nor gri listin or obey evritin wey God kommand dem thru Moses, en savant.


Dis tins go happen, bikos dem don forget mi kon dey offa sakrifice give oda gods and dem dey make mi vex, bikos of di juju wey dem make with dia hand. Una go feel my vexnashon for dis place and una nor go fit stop am.” ’


Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.


But if en shidren-shidren nor gri listin to my kommand and disobey my laws;


if dem nor gri follow my ways or do wetin I tok,


I go ponish dem with rod kon flog dem with kane, bikos of dia sturbones and sins.


Tell dem sey di Oga wey bi God sey, ‘Una must obey mi and do wetin I tish una.


Bikos Jerusalem sin well-well, God kon rijet dem like dirty rag. All di pipol wey dey honor am before, don hate am naw, bikos dem don si en nakednes and shame. Di only tin wey e fit do naw, na to dey kry with pain and hide en face with shame.


“I dey regret sey I make Saul king, bikos e don turn from mi and e nor do wetin I sey make e do.” Samuel kon vex well-well and e pray to God till day break.


“So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ