Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 9:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Solomon force some pipol build di temple, di palis and e fill di land for di east side kon build di town wall. E still use dem take ribuild Hazor, Megiddo and Geza town.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 9:15
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta dem don kapture der, David stay der kon koll am, “David Town.” E build house round am and e start from di dry land go rish di east side for di hill.


Dis na why e turn against King Solomon. King Solomon dey work for di land for di east side for Jerusalem and e dey ripair di town walls.


“Yor papa, Solomon wiked us kon make us dey do hard work. If yu sorry for us kon remove dis heavy load for awa head, wi promise sey wi go respet yu forever.”


Solomon kon tell King Fero for Egypt sey e won marry en dota. E marry and take di woman go David Town until e build en palis and di temple kon fence Jerusalem round.


Baana wey Ahilud born, dey kare for Taanak, Megiddo and all di aria for Bet-Shean near Zaretan town, for di sout-side for Jezrel town go rish Abel-Meholah and Jokmeam town.


Solomon bring 30,000 men from evriwhere for Israel make dem do di work


For Bul mont (wey bi di eight mont) for di elevent year, dem komplete di temple just as dem plan sey e go bi. Na seven years Solomon take build di temple finish.


Na twenty years Solomon take build di temple and en palis.


Doz wey kom from Ammon, Het, Periz, Hiv and Jebus dey too and dia shidren still bi slaves for Israel till today.


Solomon fill di land wey dey di east, afta en wife wey bi Egypt king pikin, don komot from David Town kon go stay di palis wey Solomon build for am.


En ofisas plan kon kill-am for Bet-Millo for di road wey face Silla.


Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.


Wen King Ahazaya for Judah si wetin happen, e kon run face Bet-Haggan. Jehu porshu am kon sey, “Make una kill-am too.” Dem shot am as e dey drive dey go Gur near Ibleam. But e still manage run until e rish Megiddo for where e for die.


Afta, Israel pipol kon fight again with Filistia pipol for Geza. For dis time, Sibbekai from Hushah kill one giant wey dem dey koll Sippai and dem kon win Filistia pipol.


Dem still give dem Shekem towns and some lands wey dey for Efraim hill kountry with Geza and dia lands too.


But King Josaya nor hear word, bikos e don ready ensef for war. E nor listin to wetin King Neko tok at-all, so e kon go fight am for Megiddo Hill.


Twenty years afta Solomon don build God Temple and en royal palis,


My God, make Yu look Zion with favor kon help am; make Yu ribuild Jerusalem walls again.


For dat time, di kry for Jerusalem go heavy pass Hadad-Rimmon wey dey near Megiddo own.


Den, Horam wey bi king for Geza kon kom help Lakish, but Joshua kill en and all en sojas finish.


Wen King Jabin for Hazor hear di news, e send message go meet King Jobab for Madon; Shimron king, Akshaf king


Efraim pipol nor fit win all Kanaan pipol wey dey stay Geza. So Kanaan pipol still dey stay with Efraim pipol till today and dem bi Efraim pipol savant.


E from der go di west side for Jafletite aria and di low arias for Bet-Horon and Geza kon end for di sea.


Near Issakar and Asher aria, dem give Manasseh, Bet-Shean, Ibleam where Dor town dey; Endor where Taanak dey and all di big and small towns wey dey near der.


Shekem (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am) wey dey Efraim kountry for di hill, Geza,


Efraim tribe nor fit drive Kanaan pipol wey dey Geza, so Kanaan pipol still dey stay der with dem.


So God kon give dem to King Jabin for Hazor for Kanaan make e rule dem. Di kommander for en sojas na Sisera, wey kom from Haroshet-Haggoyim.


Kanaan kings kom fight for Taanak near Megiddo wota, but dem nor take any silva komot der.


But if e nor dey good for una eye, make Abimelek burn Shekem and Bet-Millo men with fire. Den fire go kom out from Shekem and Bet-Millo kon burn and kill Abimelek too.”


All di leaders for Shekem and Bet-Millo kon make Abimelek king for di oak tree near di pila for Shekem.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ