Solomon kon tell King Fero for Egypt sey e won marry en dota. E marry and take di woman go David Town until e build en palis and di temple kon fence Jerusalem round.
For Bul mont (wey bi di eight mont) for di elevent year, dem komplete di temple just as dem plan sey e go bi. Na seven years Solomon take build di temple finish.
King Hiram for Tyre kon give Solomon all di cedar wood, pine wood and all di gold wey e wont for di work. Afta e don finish, Solomon kon give Hiram twenty towns for Galilee aria.