“My Oga God, make Yu remember sey I don serve Yu with all my mind and I dey always try to do evritin wey Yu wont make I do.” Den e start to kry well-well.
Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.
God kon tell Satan, “Yu know my pikin wey dem dey koll Job? Nobody bi like am for di eart; e dey klean and e good well-well. E dey fear mi well-well and e nor dey do bad tins.”
So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.