How I go take know sey I dey good for yor eye, both mi and yor pipol, Israel? Nor bi if Yu go with us (dat is, mi and yor pipol), wi go dey difren from all di oda pipol for di world?”
I dey si dem from where I stand on-top di rock; I dey look dem from di hill. Dem bi one nashon wey dey stay alone; dem know sey dem dey bless pass oda nashon.
Or God don ever try to diliver one kountry from anoda kountry with judgement, signs, wonders, war, strent, pawa or any oda tin wey dey make pesin fear like di ones wey God do for Egypt for una own eyes?