52 Oga God, make Yu always dey favor Israel yor pipol and dia king, den hear dia prayer wen ever dem koll Yu for help.
Make Yu look dis temple both for day and for nite; di place where Yu choose sey make dem for dey woship Yu.
From all di pipol, Yu choose Israel pipol to bi yor own, bikos na so Yu tell dem thru Moses yor savant, wen Yu bring dem kom out from Egypt.”
My God, make Yu dey listin and ansa all di prayers wey dem go pray to Yu from dis place.
God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind.
Yu dey good and ready to forgive awa sins and pipol wey kom meet Yu for help, Yu dey show dem yor love wey nor dey fail.