Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 8:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 make Yu still listin to yor pipol prayer. If dem turn kom meet Yu for dat land kon pray and konfess dia sin and di wiked tins wey dem don do, my Oga God, make Yu hear dia prayers.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 8:47
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen Israel pipol enemies win dem, bikos dem sin against Yu and if dem turn to Yu for dis temple kon sey, ‘Papa forgive us’,


Wen yor pipol don know wetin dem do for dat land where dem for bi prisonas, den, dem turn kom meet and dey beg make Yu forgive and remove dem from di land where dem for bi prisonas, den dem go sey, ‘Wi don sin and do anyhow! Wi don do wiked tin!’


Dem don already separate demsef from all di strenjas. Dem wear sak klot kon pak dust for dia head as sign sey dem dey sorry. Den dem kon stand dey konfess dia sins wey dem and dia grand-grand papa don kommit.


Wi don sin like awa grand-grand papa. Wi don do plenty bad tins! Wi don do wiked tins well-well!


Yu go remember how yu bihave, den shame go katch yu wen yor senior and yonga sista go kom back kon meet yu. I go let dem bi like yor pikin.


I go forgive yu all di bad tins wey yu don do, but wen yu remember dem, shame nor go let yu open yor mout.” God wey get pawa don tok.


bikos e si sey wetin e dey do nor good, so e kon stop to dey sin. E nor go die at-all, but e go live.


“God wey get pawa sey, ‘Make una tink about wetin dey happen to una naw.’


Even doh I skata dem go oda nashons, dem go remember mi for anywhere wey dem dey. Dem with dia shidren wey survive, go kom back to Israel land.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


Afta dem don gada for Mizpa, dem kon draw wota pour put for God front. Dem nor chop for dat day and dem kon konfess all dia sins for der dey sey, “Wi know sey wi don sin against God.” So Samuel pray for Israel pipol for Mizpa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ