31 If dem tok sey pesin do anoda pesin bad and dem bring am kom yor altar for dis temple, den e swear sey e nor do am,
my Oga God, make Yu listin from heaven, den kon judge yor savants. Make Yu ponish di one wey do bad as e fit am kon free di one wey dey rite.
Bikos if I too get money, I fit deny Yu sey, ‘Who bi God?’ And if I too poor, I go fit go tif kon bring shame for yor holy name.
“ ‘If dem koll yu make yu kon tok about sometin wey yu si or wey happen for yor present and yu nor gri, yu don sin bi dat and dem must ponish yu.
If man sin against man, pesin fit beg God to forgi-am. But if man sin against God, na who go kon pray for am?” But di boys nor gri listin to dia papa, bikos God don sey E go kill dem.