Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 8:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Den, for di pipol present, Solomon go stand for di altar front, raiz en hand

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 8:22
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta Solomon don pray to God finish, e stand for di altar front where e knee down and raiz en hand since.


Den Atalaya look well kon si di king stand near di pila akordin to dia tradishon. Doz wey dey kommand and blow trumpet stand near di king and all di pipol for di land dey happy kon dey blow trumpet. Atalaya tear en klot kon sey, “Dis na plan work! Una really plan dis one o-o!”


Di king stand near di pila kon promise to obey di kovenant wey dem make with God before. E promise to use en whole heart take obey God law, evry oda tin wey God tok and to do evritin wey dey di book. All di pipol agri to obey di kovenant too.


Wen di time don rish for di evening sakrifice, I get up from where I sidan, but I still wear my tear-tear klot kon knee down, stresh my hand to di Oga my God kon pray.


But for yu Job! Make yor heart dey rite before yu koll God.


Make Yu listin to my prayer for mesi as I dey kry to Yu for help and as I lift up my hand for yor holy temple.


I go praiz Yu as long as I dey dis life and I go raiz my hand kon pray give Yu.


Wen all di pipol si di pila with kloud for di gate, each pesin for en gate go stand up kon woship God.


Moses ansa am, “Wen I komot go inside town I go stresh my two hand go heaven to di Oga wey bi God, den di tonda go stop and di ice-blok nor go fall again, so dat yu go know sey na Oga God get di whole world.


So Moses waka leave Fero kon go inside di town stresh en two hand go heaven as e dey pray and di tonda, di ice-blok and di rain kon stop to fall.


Wen una raiz una hand dey pray, I nor go look una. Even if una pray many prayers, I nor go listin, bikos blood don stain una hand.


So, I wont make evribody dey pray for evriwhere, dey raiz dia holy hand without vexnashon or kworel.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ