E make ten basin wey dem fit take wosh: E put five for di sout and five for di nort side. Na inside di basin dem for dey wosh di tins wey dem dey take do di burnt sakrifice; but di priest dey wosh inside “Di Sea.”
Wen Solomon don build God Temple finish, di holy tins wey bi en papa David own (tins like: silva, gold and all di oda tins) e pak dem put inside di store room for di temple.