King Ahaz orda Uriaya kon tell am, “Make yu offa di morning sakrifice for di big altar, plus di evening ofrin, di royal burnt sakrifice, di food ofrin, di burnt sakrifice for Israel pipol, dia food sakrifice and evry oda sakrifice. Na only mi go dey use dis bronze altar.”
King Ahaz kut di stand komot kon remove di basin from dem. E take “Di Sea” from di bull wey dem make with bronze and wey dey support am kon put am for groun.
Babilon sojas break di two bronze pila wey dey God Temple, plus di stand wey dem dey move and di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea.” Dem karry di bronze dem go Babilon.
E still take many bronze from Tibhat and Kun where Hadadeza for dey rule. (Na Solomon use all dis bronze take build tank, kolumns and oda bronze tins for di temple.)
E still make one bronze basin kon koll am “Di Sea.” If dem measure am from one side to di oda, na 15 fit e bi; e round for shape kon high rish seven and half fit. Di basin round rish 45 fit.
Babilon pipol break di two bronze pilas wey dey God temple front; di bronze wota pot and di big bronze basin, wey dem still dey koll, “Di Sea.” So dem karry all di bronze go Babilon.
Di two pilas, di Sea with di twelf bronze melu image wey dey under am and di wota pot and wetin dem karry, many well-well. Dem make and put dis tins for God temple wen King Solomon dey rule.