10 Na betta-betta stones dem take make di foundashon. Some long rish twelf and odas, na fifteen fit.
On-top di foundashon, di best stones wey dem karve for di rite side, na-im dem use with di cedar wood.
Na di best stones dem take build and karve all dis tins kon kut dem with saw; from di roof foundashon and from di outside go rish di great kourtyard.
Naw, dis na wetin God tok, “I dey put one foundashon stone for Zion and dem rite dis word put, ‘Di pesin wey bilive and get faith, make e nor fear.’
God sey, “My Jerusalem; di town wey dey sofa and nor get help; di place wey nor get who go konfort am. I go use stones wey dear well-well take build una foundashon again.