Di rooms for outside na three story building and di bottom floor wide rish seven and half fit, di middle floor na 9 fit while di top floor na ten and half fit. E build di room join di temple but dia timba nor enter di wall.
Dat time, di church wey dey Judea, Galilee and Samaria get rest and dis kon make dem strong as dem dey stay togeda, dey woship God with all dia heart and as di Holy Spirit dey tok to dem. So pipol wey dey di church kon dey plenty more-more.
So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.