38 For Bul mont (wey bi di eight mont) for di elevent year, dem komplete di temple just as dem plan sey e go bi. Na seven years Solomon take build di temple finish.
Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.
David tell Solomon en pikin, “Make yu nor fear, but start di work with strong heart and nor let anytin stop yu. God wey I dey serve, go dey with yu. E nor go abandon yu, but E go stay with yu till yu finish di temple and evritin wey go dey inside.
All di work wey Solomon sey make dem do, rite from di day wey dem lay di foundashon for God Temple until dem finish am, dem do all komplete. So, dem kon finish all di work for God Temple.