Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.
For Bul mont (wey bi di eight mont) for di elevent year, dem komplete di temple just as dem plan sey e go bi. Na seven years Solomon take build di temple finish.
All di work wey Solomon sey make dem do, rite from di day wey dem lay di foundashon for God Temple until dem finish am, dem do all komplete. So, dem kon finish all di work for God Temple.