Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 6:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 Dem use creatures wey dem karve with feadas, palm tree and flower, take dekorate di wall both for inside and outside.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 6:29
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem dekorate di cedar panels with tins wey den karve and with flowers, den dem use cedar wood kover di inside, so dat dem nor go si di stones wey dey di wall.


Na gold dem use take make di two creatures.


Di two doors wey dem make with olive wood, dem karve doz creatures with feadas, palm tree and flower put kon kover dem with gold.


Na violet, purpol, crimson and white klot, Solomon take make di curtain kon design and dekorate am with tins wey bi like angels.


E still design di house, di beams, di wall, di post and all di doors wey dey di temple and e karve tins wey bi like angel for di walls.


So angels, make una praiz God: Di strong angels wey dey obey am and listin to all en kommand.


Make all en angels praiz am! Make all di sojas for heaven, praiz am!


Dem use axe and knife take skata evritin wey dem karve


“Make yu still make di Tabanako with ten curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool. Make yu make di curtains like angel wey get feada and na who dey design go do dis work.


All di pipol wey sabi work, make ten curtain for di Tabanako with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool kon design am with image wey bi like angel.


Small-small whole dey di outside wall for all di rooms and di inside wall wey dey between di rooms. Dem karve palm trees for di inside wall wey face di road.


Dem karve angel put for der kon design am with palm tree and palm tree still dey di two angel middle. Each angel wey dem karve get two face:


E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.


Afta all dis tins, I look up kon si crowd wey nobody fit kount. Dem kom from difren tribe, kountry, group, language and dem stand for di throne and di Lamb front. Dem wear white klot kon whole palm tree branches for hand


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ