1 Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.
Pipol from far go kom join build God temple again. And wen dem don build am finish, yu go know sey na God wey dey mighty send mi kom meet yu. All dis tins go happen if yu use yor whole heart take obey all wetin di Oga yor God kommand yu.” ’ ”
God kon tell Moses for di place where dem for dey do meetin for Sinai Wildaness, for di first day, for di sekond mont for di sekond year, afta dem don komot from Egypt:
Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.”
So Christ don bi High Priest for di good tins wey don kom. E don enter di Holy Place for heaven wey dey pafet. Nor bi human being make di place and e nor dey among tins wey God kreate for dis world.
So unasef too, don bi stone wey dey alive and God dey build una as en spiritual house, so dat una go bi priest wey dey holy and una go offa spiritual sakrifice wey E go asept thru Jesus Christ.
For three hundred years naw, Israel pipol dey stay for Heshbon and di towns wey dey near am; Aroer and di towns wey dey near am and di oda town wey dey Arnon! Why yu nor kom klaim di land, dat time?