E turn from Baalah face west for Mount Seir kon cross di lowland for Mount Jearim go nort (wey bi Kesalon), den land for Bet-Shemesh kon cross go Timnah.
Amor pipol still dey stay for Mount Heres, Aijalon and Shaalbim, but wen Josef shidren-shidren don strong well-well, dem kon force Amor pipol to work as dia slave.
Den di melu kon go strait to Bet-Shemesh. Dem dey make nois as dem dey go. Dem nor turn face left or rite. Filistia pipol leaders follow dem for back until dem rish Bet-Shemesh borda.
Di pipol wey dey stay Bet-Shemesh kon ask, “Na who go fit stand before di Oga awa God wey dey holy? Na where wi won send di box go, so dat God go leave us?”
But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”