E rite about trees and plants, like di cedar wey dey Lebanon and di plant wey dey grow for wall. E still rite about animals, birds, animals wey dey creep and fish.
Wen Sheba kween hear about Solomon, di woman kon go ask am strong-strong kweshon. Di kween rish Jerusalem with many pipol and many kamel wey karry spices, plenty gold and precious jewels. Wen di kween meet Solomon, e tell am evritin wey e get for en mind.
God wey dey lead heaven sojas sey, “For dat time, ten strenjas go kom meet one Jew pesin sey, ‘Wi won share from yor blessings, bikos wi hear sey God dey with yu.’ ”