32 E rite 3,000 parabol and di songs wey e rite, pass 1,000.
E rite about trees and plants, like di cedar wey dey Lebanon and di plant wey dey grow for wall. E still rite about animals, birds, animals wey dey creep and fish.
Dis na di wise words wey Solomon tok: Shidren wey wise dey make dia papa proud, but fools dey kause pain for dia mama.
Dis na some of Solomon oda wise words and na King Hezekaya men for Judah kourt, rite dem down.
But my pikin, make I warn yu: nor add join dis words; bikos pipol go still dey rite many book and too mush readin, go make yu kwik old.
Nor bi sey na only sense di tisha get, but e still dey tish di pipol how to get wisdom. E take en time take tish and show dem many proverbs.
E do am so dat wetin di profet tok, go happen: “I go open my mout tok parabol, I go tok evritin wey bi sekret since God kreate dis world.”