Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 4:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 God give Solomon betta wisdom, sense and en undastandin big well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 4:29
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di korn and rice wey Josef keep, many well-well like san-san wey dey near sea and e nor fit measure dem again, bikos dem too plenty.


I go do wetin yu ask. I go give yu wisdom and undastandin wey pass di ones wey anybody don get before or go get afta yu.


Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.


Israel and Judah pipol plenty like san-san for wotaside; dem get enough food to chop and drink and dem dey happy.


I go run follow yor kommands, bikos Yu dey make mi undastand life well-well.


Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.


Na God dey give wisdom! Na from en mout knowledge and undastandin dey from kom.


Den I tell mysef, “Na mi wise pass evry oda king wey don rule for Jerusalem before mi. Bikos I get wisdom and undastandin wey dem nor get.”


God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.


Una go si dis tins kon happy; una go dey happy as una dey waka. Dem go bring all di nashons propaty kom give una. Dem go bring dia money from di oda side of di river kom.


I go make my savant, David shidren-shidren and all di priest from Levi tribe plenty, so dat dem nor go fit kount dem, just as dem nor fit kount star for sky or san-san for wotaside.”


Na-im dey shange time and sizin; dey make and distroy kings. E dey give wisdom, undastandin and knowledge to wise pipol.


All of dem dey kom with wahala; dey rush dey kom like breeze for desert and dem go gada di pipol wey dem katch like sey dem dey gada san.


bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.


But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.


But God wisdom dey pure; e get peace; dey gentol; dey asept pipol and good fruit and mesi full am; e nor dey do wayo or pritend.


Midian and Amalek pipol and di men wey dey stay di desert, many for di valley like worm and dia kamel many like san-san for wotaside.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ