“I dey advise yu sey make yu bring all Israel pipol togeda, even doh dem many like san for wotaside kon skata for evriwhere for di kountry. Make yu yorsef lead dem go di war.
So God kon send bad sickness kom Israel, wey last from dat morning go rish di time wey E choose. From one end go rish di oda end for di kountry, na 70,000 pipol die for Israel.
“Make una nor listin to Hezekaya! Bikos Assyria king sey, ‘Make una rite leta kom sey una go respet am and do anytin wey e tok. Den each of una fit chop from di vine and fig kon drink wota from well,
But E promise mi sey, ‘Yor pikin go rule with peace, bikos I go make all en enemies love am. Di pikin name go bi Solomon, bikos for en time, I go give Israel pipol peace kon guide dem.
“Make una nor listin to Hezekaya! And naw, Assyria king dey kommand una sey, make una surenda. Dem go let all of una chop grapes from una own vine and figs from una own trees kon drink wota from una own well,
Dem nor go hear wahala sound again for dis town; distroshon nor go skata una kountry again. I go protet and defend una like wall; den una go praiz mi, bikos I don save una.
Evribody go stay for peace and dem go prosper. Dem go enjoy dia own grape and fig tree, bikos e nor get anytin wey go make dem fear. God wey dey mighty don promise!
And for dat day, una go invite una neighbours make dem kom sidan with una under una vine and fig tree, bikos una go get peace.” Dis na wetin Oga God tok.
Israel pipol for nort for Dan kountry go rish Beersheba for sout and even Gilead land for east, ansa di koll. Dem gada togeda as one for God present for Mizpa.