Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 4:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Ben-Geber dey kare for Ramot town for Ramot Gilead and all di village for Ramot wey Jair town get and na Manasseh grand-grand pikin e bi. E still dey kare for all di aria for Argob for Bashan wey bi sixty big towns wey dem fence round and e get bronze bars.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 4:13
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Ahab ask en ofisas, “Since na wi get Ramot for Gilead, wetin make us neva try to kollect am back from Siria king?”


Naw, Elisha koll one among di profet sons kon sey, “Wear yor klot, den take dis olive oil kontaina go Ramot for Gilead.


Den Jehu kon dey plan against King Joram wey dey Ramot Gilead dey trit ensef from di wound wey e get from di fight against King Hazael for Siria.


But Geshur and Aram win Jair, Kenat and sixty towns for der. All dis shidren na Makir wey bi Gilead papa grand-grand shidren.


My enemies gada round mi like strong melu and wiked animals from Bashan. Dem gada won bite mi!


Mount Bashan high well-well; Bashan mountin get many top.


Naw, Jair wey Manasseh born kon go attack and take some small village and e name dem Havvot-Jair.


all di towns wey dey di high lands, all di lands for Gilead and Bashan go rish Salekah and Edrei, di towns wey bi King Og for Bashan, own.


For dat time, wi kollect all di towns wey e get. E nor get any town wey wi nor take from dem. Wi take sixty towns and all di aria for Argob wey bi Bashan main kingdom.


So for dat time, wi take di two king for Amor land for (Trans-Jordan) go rish River Arnon and Mount Hermon


Dis towns na: Beza wey dey di wildaness high land for Reuben tribe; Ramot for Gilead wey bi Gad tribe own and Golan for Bashan wey bi Manasseh tribe own.


Afta dem cross Jordan River for di east side for Jeriko, dem kon selet Beza for di desert wey bilong to Reuben tribe, Ramot for Gilead wey bilong to Gad tribe and Golan for Bashan wey bilong to Manasseh tribe.


From Gad tribe, dem give dem: Ramot for Gilead (di town wey pesin fit hide put make dem for nor kill-am), Mahanaim,


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ