But I nor go take di whole kingdom from am. Instead, I go leave one tribe for am bikos of David, my savant and bikos of Jerusalem, di town wey I dey stay.”
Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.
All dis men na sojas wey dey ready to fight. Dem kom Hebron kon make David king ova Israel pipol. In-short, evribody for Israel gri sey make David bi dia king.
I still tell dem, “Na wimen from anoda kountry make King Solomon sin. Dis man great pass any of di king for oda nashons. God love am kon make am king ova Israel pipol, yet e still kommit sin.