Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 3:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Wen Solomon wake-up, e kon undastand sey God don tok to am for dream. Den e go Jerusalem go stand for God Kovenant Box front kon offa burn and fellowship ofrin give God. Afta, e do party for all en ofisas.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 3:15
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den Jakob wake-up kon sey, “True-true, God dey dis place and I nor know!”


and Jakob offa sakrifice for di hill kon koll en men kom chop bread. Dem chop bread kon sleep for di hill dat nite.


So e happen sey for di third day, wey bi Fero birtday, e kon do party for all en savants and e sey make dem release both di man wey dey serve am wine and di one wey dey bake.


Di seven tin korn kon swallow di seven fat and fine ones. Den Fero wake-up kon si sey na dream e dey dream.


One day, two wimen wey dey do ashawo work kom judge dia matter give Solomon.


Dem sakrifice 22,000 melu and 120,000 sheep as fellowship ofrin. So di king and all di pipol dedikate di temple.


For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.


all of dem kon chop beleful. E give bread, meat wey dem roast and rice to each pesin for Israel.


King Solomon sakrifice 22,000 kattle and 120,000 sheep. Den en and all di pipol dedikate God Temple.


and for di third year wen e dey rule, e kon do party for all en ofisas and savants. Di sojas for Persia and Media dey der too, with di ofisas and strong men for di kountries.


Den pipol go sey, ‘Wi sleep in peace and wake-up in peace.’ ”


King Belshazzar do party for en royal men wey rish 1,000 and e kon drink wine togeda with dem.


God tell dem, “Make una listin to mi: “If anybody bi profet among una, mi God go show mysef to am thru vishon kon tok with am for dream.


But one day wen Herod dey do en birtday, en ofisas, en sojas oga dem and di leaders for Galilee, dey der with am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ