I still tell dem, “Na wimen from anoda kountry make King Solomon sin. Dis man great pass any of di king for oda nashons. God love am kon make am king ova Israel pipol, yet e still kommit sin.
God dey give some pipol many propaty, honor and evritin wey dem wont, but E nor dey give dem di shance to enjoy dem. Dem go die, den anoda pesin go help dem enjoy dia propaty! Dis one dey yuzles and bad well-well.