Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 3:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Solomon kon tell King Fero for Egypt sey e won marry en dota. E marry and take di woman go David Town until e build en palis and di temple kon fence Jerusalem round.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 3:1
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But David win Zion take and dem kon dey koll am, “David Town.”


Solomon kon love many wimen wey kom from oda kountry. Apart from Fero pikin wey bi en wife, e still marry plenty wimen from Hit, Moab, Ammon, Edom and Sidon kountries.


Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.


Solomon still build palis for ensef and na thirteen years e take build am.


Na so too dem take make di palis where Solomon dey stay. E still build one palis like en own kon gi-am to Fero dota wey e marry.


Afta Solomon don build di temple, di palis and evritin wey e won build,


Na twenty years Solomon take build di temple and en palis.


Solomon fill di land wey dey di east, afta en wife wey bi Egypt king pikin, don komot from David Town kon go stay di palis wey Solomon build for am.


David go stay for where dia betta propaty dey and na dis make dem dey koll am, David Town.


Afta King Jehoshafat get money kon popula well-well, e sey make one pesin for en family marry from King Ahab family for Israel.


Solomon karry Fero dota from David Town go di palis wey e build for am kon sey, “My wife nor go stay for di palis wey bi Israel king, David own, bikos di place where di Kovenant Box enter, dey holy.”


But dem ansa, Wi bi God for heaven and eart savants and wi dey ribuild di temple wey one pawaful king for Israel build before.


So, how wi go forget yor kommand again kon go marry doz wiked pipol? If wi do am, Yu go vex kon distroy us finish and nobody go survive.


Di third generashon for Edom and Egypt pipol fit enter God present.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ