Isaak ansa, “Si! I don make am oga ova yu. I don make evribody wey rilate to am to bi en savant kon bless am with many korn and wine. Wetin dey naw wey I go fit do for yu, my pikin?”
Solomon get plenty ship wey dey move with Hiram ship. Wen Solomon ship dem kom back evry three years, dem dey bring gold, silva, ivory, apes and fawol kom.
Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey, “Make wi tank God, bikos en love na forever and ever.”
Di king get many ship wey go Tarshish with Hiram savants. Wons evry three years, di ship dey kom back with plenty gold, silva, ivory, apes and peacocks.
Kings dota dey join doz wey kom visit yu and yor kween go wear fine-fine gold and silva wey dem make for Ofir town kon stand near yu for yor rite side!
Di ship dem dey kom from far; dem dey karry God pipol with silva and gold kom back to dia house and to take honor God name, di Oga wey bi Israel pipol God wey dey holy and all di nashon dey honor en pipol.
But Jonah kon plan to run go anoda place, bikos e nor won do wetin God tell am. E travel go Joppa where e for si one ship wey karry load dey go Tarshish. So e buy tiket kon enter di ship, so dat e go fit hide from God.