45 Di remainin tins wey King Jehoshafat do; with all en good works and di sojas wey e get, dem rite dem for Judah kings history book.
Evry oda tin wey Solomon do; en works and wisdom, dem rite dem for Solomon history book.
Evry oda tin wey Jeroboam do, di war wey e fight and how e rule, dem rite dem for Israel kings history book.
Evry oda tin wey Rehoboam do, dem rite dem put for Judah king history book.
Afta King Jehoshafat get money kon popula well-well, e sey make one pesin for en family marry from King Ahab family for Israel.
Di remainin tins wey Jehoshafat do from biginnin go rish end, dem rite am for Hanani pikin, Profet Jehu book kon put am join Israel kings history book.