1 Kings 22:39 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
39 Di remainin tins wey Ahab do wen e bi king; with evritin wey e get and how e build big palis and difren towns, dem rite dem for Israel kings history book.
Solomon get plenty ship wey dey move with Hiram ship. Wen Solomon ship dem kom back evry three years, dem dey bring gold, silva, ivory, apes and fawol kom.
Rhodes pipol dey buy and sell with una; many pipol wey dey stay near sea dey give una ivory and eboni wood, so dat una go give dem some of wetin una get.
I go distroy all di house wey rish pipol build bikos of rain and dry sizin. All di house wey dem use ivory stone take dekorate, go fall skata and di big-big house go skata finish.’ ” Na so Oga God tok.