Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 22:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Profet Mikah still sey, “Dis na wetin don happen. God don make dis profets lie to yu. But en ensef don tok sey yu go si wahala!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 22:23
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di profet kon tell di king, “Dis na wetin God sey make I tell yu, ‘Bikos yu let di man wey I sey make dem kill eskape, yu go use yor life pay for en own and dem go distroy yor sojas, bikos dem let en sojas eskape.’ ”


Make yu tell am, ‘Mi wey bi God sey, “Afta yu don kill pesin finish, yu won still take en propaty too?” ’ Still tell am sey, ‘Na for where dog for lick Nabot blood, na der too, dogs go for lick yor own blood!’ ”


Den Profet Zedekaya wey bi Kenaana pikin, waka kom meet and slap Mikaya, den e ask am, “Since wen God Spirit leave mi kon dey tok to yu?”


As e dey tok, King Amazaya kon tell am, “Na who choose yu to advise di king? Make yu stop to profesai or dem go kill yu trowey!” Di profet stop kon sey, “I know sey God one distroy yu, bikos of dis tins wey yu do and yu nor gri listin to my advise.”


But God still make Fero heart strong and e nor gri free Israel pipol.


God tell Moses, “Wen yu go back to Egypt, yu must do all dis mirakle and sign for Fero front, bikos I don put pawa for yor hand. But I go make Fero heart strong well-well and e nor go gri free my pipol.


But evil pipol own don finish, bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.


E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”


So naw, tell Judah and Jerusalem pipol sey, ‘I dey plan and dey ready to ponish dem.’ Tell dem make dem stop to dey sin kon shange di way dem dey live dia life and di tins wey dem dey do.


“If any profet give una wrong massage, make una know sey na mi wey bi God do am like dat. But I go still rijet and remove am from among my pipol for Israel.


‘Even if yu give mi yor house with all yor silva and gold, I nor go fit disobey God kommand to do evil or good just as I wont am, but na anytin wey God tell mi, I go tok.’


But King Sihon for Heshbon nor gri, bikos na so God wont make e bi, so dat E go fit give di land to us today.


Den God kon make Abimelek and Shekem men bigin fight demsef and dem kon go against am.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ