19 Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am.
God ask, ‘Na who go-go deceive King Ahab, so dat dem go kill-am for Ramot Gilead?’ “Di angels kon dey tok difren tins,
Naw, wen di day rish for God angels to gada before God, Satan follow dem kom too.
For anoda day, wen God angels gada before God again, Satan sef follow dem kom too.
Una must nor serve anoda god; una must nor bow before any oda god.
and dem si Israel God. Sometin wey bi like karpet wey dem take safaya stone make dey under en leg and e klear like sky.
Moses and Aaron, Nadab and Abihu and di seventy eldas for Israel kon go di mountin
So Sodom leaders, make una listin to wetin God dey tell una. Gomorrah pipol, make una put ear for wetin God dey tish una.
So, all di sturbon and wiked rulers for Jerusalem, make una listin to wetin God dey tok.
Naw, Jakob shidren-shidren and Israel family, make una listin to God word.
All of una wey I send go Babilon as prisonas, make una listin to wetin mi wey bi God dey tok.’
If una wey remain for Judah do like dat, den make una hear wetin Israel God dey tok, ‘If una don gri sey una won go stay for Egypt,
“Man pikin, make yu tok against di profets for Israel. Profets wey dey tell pipol anytin wey dem like. Go tell dem sey: ‘Make una hear God word!
So, Jerusalem, make yu hear mi naw! Hear wetin God dey tok.
So naw, make yu listin to wetin God tok. Yu sey make I stop to profesai and warn Israel pipol; make I nor prish against Isaak family, abi?
Den di man wey stand near di myrtle tree kon sey, “Na God send dem make dem go look how di eart bi.”
Den e start to profesai: “Balaam wey Beor born, naim message bi dis; di man wey en eyes open well-well, na en word bi dis;
“Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.
“Wen Man Pikin and en angels go kom with en glory, e go sidan for en king throne.
All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.
God tok about di angels sey, “I make my angels and my savants spirit to dey burn like fire,”
Instead, una don kom Mount Zion; di town where God dey stay; di Jerusalem for heaven where tazon angels dey. Una don enter di assembly,
As I dey look, I kon hear many tazon angels vois as dem stand round di throne; di for creatures and di eldas.
Naw, God Spirit don komot from Saul body and God kon send one wiked spirit make e dey ponish am.