18 Den King Ahab tell King Jehoshafat, “I nor tell yu sey e nor dey profesai anytin wey dey good for mi? Na only bad tin e dey profesai for mi!”
Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am.
King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”
Raitious pipol dey get wetin dem wont, but wetin wiked pipol dey get, na di tin wey dem fear pass.
Even if yu beat foolish pesin almost die, yu nor go fit beat en foolishness komot for en body.
If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again.
One man wey know di law well-well kon ansa, “Tisha, yu dey curse us as yu dey tok like dis so o-o.”