13 Di ofisas wey go koll Mikaya kon tell am, “All di oda profets don profesai viktory give di king. So make yu do di same tin.”
All di oda profets tok di same tin kon sey, “Make yu go attack Ramot for Gilead and yu go win dem, bikos God go give yu viktory.”
But Profet Mikaya ansa, “I promise una with God wey dey alive sey, I go only tok wetin God sey make I tok!”
Wiked pipol dey sey, “God nor dey si us! E don klose en eye and E nor go even fit si wetin wi dey do!”
I bilive and trust sey God go protet mi. So wetin make yu dey sey, “Fly like bird go hide for mountin, so dat yu go dey save,
Na only fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem nor good at-all and dia ways bad well-well. No one among dem dey do wetin good!
As una dey do all dis tins, I nor tok at-all and una feel sey I nor kare. But naw, I go distroy una kon rite evritin wey I get against una.
Di pipol dey deceive di king and en ofisas with all dia evil plans and di prince dem dey make di king happy with dia lie-lie words.
If lie-lie profet kon tell una sey, “Make una dey drink wine and plenty strong drink!” Una go happy, bikos dat na di kind profet wey una dey like!