“Yu don si how King Ahab honbol ensef for mi since wen yu tell am wetin I tok? I nor go bring wahala kon gi-am wen e still dey life, but na en pikin go take head karry am.”
Wen God si sey dem don turn kom meet am, E kon tell Profet Shemaya sey, “Dem don honbol demsef, so I nor go distroy dem again. I go soon diliver dem. I nor go use Shishak take show Jerusalem pipol as I dey vex rish.