Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Kings 21:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 (E nor get any oda pesin wey do dis kind bad tin for God present, like Ahab, just bikos of en wife Jezebel.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Kings 21:25
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Omri sin worse pass di sin wey doz wey don rule before am, do.


Elijah ansa, “I nor bring wahala kom Israel. But na yu and yor papa family bring wahala as una abandon God kommand kon follow Baal.


Wen Jezebel dey kill God profets, Obadaya hide hundred profets for two kave; fifty-fifty for each kave and e dey bring food and wota kon give dem.


Jezebel kon send message go meet Elijah dey warn am sey, “Make di juju dem judge mi, if I nor kill yu by dis time tumoro, just as yu kill di Baal profets.”


Wen King Ahab si Elijah, e kon sey, “My enemy, yu don find mi si abi?” Elijah ansa, “Yes! I don find yu si. Yu don do wetin nor dey good at-all for God eye.


Jezebel ansa, “Nor bi yu bi di king? Make yu stand up from bed go chop. I go make sure sey yu take Nabot vineyard!”


E nor obey God and e dey do di kind bad-bad tins wey en papa and mama do. E make Israel pipol sin, just as Jeroboam wey bi Nebat pikin, tell dem to do.


E woship Baal kon make di Oga wey bi Israel pipol God vex and na so en papa do too.


Dem offa dia shidren as sakrifice and dey do majik and oda bad-bad tins. Dem decide to dey do bad tins for God present and na dis make God dey vex.


E nor get any king before or afta wey turn kom meet God like King Josaya wey use en whole heart take serve God, just as Moses Law tok.


Wen King Joram si Jehu, e kon ask, “Jehu, hope evritin dey okay?” Jehu ansa, “How evritin won take dey okay wen yor mama still dey make pipol serve juju and do oda bad tins.”


Jehu enter di palis kon sidan chop for der. Den e sey, “Make una go trowey dis wiked woman dead body. Make una beri am, bikos na king pikin e bi.”


I still tell dem, “Na wimen from anoda kountry make King Solomon sin. Dis man great pass any of di king for oda nashons. God love am kon make am king ova Israel pipol, yet e still kommit sin.


marry dia dotas for una sons and dia dotas go make una nor serve mi well, instead una go kon dey woship dia juju.


Pesin wife wey dey sleep with oda men, dey get sweet mout and doz wey God dey vex for, dey fall enter di woman trap


I still si sey, woman wey wont make man sleep with am, dey set trap for am and dis one dey wiked and bad pass deat. Pipol wey dey obey God, go fit eskape am, but doz wey dey sin, go enter di trap.


Dis na wetin God tok: “Una tink sey I drive my pipol komot like man wey drive en wife komot en house? Where di leta wey I take drive una mama? Una tink sey I sell una as slave like man wey sell en shidren? No! Una bi slave, bikos of una sins and dem karry una komot from una land, bikos of di bad-bad tins wey una do.


God wey get pawa dey tell en pipol sey, “Wen una bi slave, dem nor pay any money take buy una, na so too, dem nor go pay anytin to take free una.


But di Jew pipol wey nor gri bilive, gada di Gentile pipol kon spoil dia mind against Paul and Banabas.


Dem lie for Stefen head, so di pipol, di eldas and di oga dem for di law kon hate am. So dem arrest Stefen kon karry am go di kansol.


(I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.


Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin.


But dis na wetin I get against yu: yu allow dat woman, Jezebel, make e dey do wetin e like. Dat woman wey koll ensef profet and di tins wey e dey tish dey make my savants sin, bikos dem dey sleep with who nor bi dia husband or wife and dem dey chop juju food.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ