King Joram kon sey, “Make una ready my horse.” Wen dem don ready en horse, King Joram for Israel and King Ahazaya for Judah kon enter dia horse go meet Jehu. Dem meet am for one land wey bi Nabot for Jezrel own before.
Jehu kon orda Bidkar, en offisa sey, “Make yu go karry en dead body trow for di land wey bi Nabot for Jezrel own before. Remember sey mi and yu dey ride with Ahab en papa wen God tok about dis tins sey,
Even with all dis ponishment from God, Israel pipol nor gri turn from sin go meet di Pesin wey go save dem. Dem nor even tink to setol with di Oga God wey dey lead heaven sojas.
My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.
Wen dem wont pesin land, dem go dey find how dem go take seize am and wen dem wont pesin house too, dem dey take am by force. Dem dey opress, shit and take pipol propaty.